ADC National Convention hold inside venue palava, party accuse govment of sabotage
Di African Democratic Congress (ADC) insist say dia national convention wey dem bin don schedule for Tuesday, 14 April 2026 go hold, despite controversy ova di leadership of di party and drama wey dem dey face in securing venue for di Federal Capital Territory, Abuja.
Former member of di Nigerian Senate wey now be ADC member, Senator Dino Melaye, accuse di ruling party and FCT administration of frustrating dia venue arrangement.
“We be di owners of dis place, we sign contract, we sign agreement and dem open di place. We come dey hia around 11:pm yesterday, dem tok say order come from di office of di FCT minister and from above say make we go out.
Dem say dem wan lock up di place. I say, we don pay, we don sign agreement, why? dem say no, dem no fit do am again, say make we comot. Na im we say we no dey comot oh. Na im we dey since yesterday, dem no put on light, no water, no notin. Di light wey dey work now, na we carry our generator come. AC no dey work,” Melaye tok.
BBC News Pidgin reach out to di Rainbow Events Centre for Abuja ontop di mata but dem neva respond to request for comment.
Melaye allegation dey come afta former Nigeria Vice President Abubakar Atiku raise alarm, make allegation early on Tuesday for im social media handle say di FCT administration dey threaten to cancel di license of di owners of di Rainbow Events Centre if di ADC convention true-true happun for dia.
“To force a private business owner to deny a lawfully registered opposition party di use of a venue no be governance, e no be politics, na di naked conduct of a regime wey don lose di argument, lose di pipo, and now, dem dey reach for di boot bicos notin remain for dem,” Atiku tok.
“Di ADC don pay evri fee. Di ADC don sign evri contract. Di ADC no break any law.”
